Everybody dey online. Everybody dey scroll. To catch person eye, your caption gats loud, clear, and straight to the point. Here's how to write mad caption ๐Ÿ‘‡

Everybody dey online. Everybody dey scroll. To catch person eye, your caption gats loud, clear, and straight to the point.

If you write caption like say you dey beg, people go just waka pass. But if you hit their daily pain and joy, dem go stop, read, maybe even comment or click. Na psychology be that — people sabi respond to wetin touch them.

When person dey see your post, the first thing wey go run for their mind na:

- “Wetin concern me here?”
- “Abi this one dey talk my story?”
- “Na who dey pepper me like this?”

So, you gats mirror how people dey think and feel. Use their own wahala and wish to write your caption.

For example, if na food business you dey run, caption like:

“Work stress wan finish me, I just need small jollof wey go reset my head”_ go grab attention pass _“Buy rice from us today.”

If na fashion:

“Who else dey wear slippers wey don bend like plantain leaf? Make we upgrade together.”

People dey expect real talk. Dem don tire for fake packaging. So if your caption feel like gist, like advice from friend, like shout-out to their hustle — dem go engage.

Always add small drama, small street sense. Make your caption short, punchy, and make e shout identity.

And no forget to end am with hashtags wey go meet your target audience.


—Jbm Sopuruchukwu 
Best Advertising Copywriter in Nigeria.

Popular posts from this blog

HOW TO CHOOSE THE RIGHT COURSES WHEN YOU'RE BROKE AND STARTING ONLINE

The day I discovered why okrika sellers show you the torn shirt first before the good one, my whole life changed forever

Why is it that every time someone wants to buy land or a house in Nigeria, the first thing they ask is, “Hope it’s not scam?”

If you're into fashion, Stop posting only the outfit. Start posting the feeling. Here's what I mean....

When a Nigerian says "I go think about it," what they really mean is:

Your Advert is Not Bringing Customers? This is How I Fixed Mine

THE CUSTOMER WHO CAN'T AFFORD IT WILL STILL PRICE IT FOR HOURS

If you can’t solve one sharp problem for your audience, they won’t remember your name.

Why Musa’s Jollof Rice Recipe Never Made Him Money